Jokes : 10 Stupid Questions People Ask

10 STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK
.
JOOO
1. You see identical twins, you
still dey ask 'na twins be dis'?
No bros, na picmix...lol
.
2. Nepa brings light and
everyone in the neighborhood
shouts 'up Nepaaa'! My guy ask
me, O boy na light be that?
No oh, Na Holy Ghost fire! Lol!
.
3. You see person dey vomit, you
still dey ask am 'you no well'?
Em well, e juz dey practice how
to vomit.
.
4. You just wake up from sleep
person come ask you "you don
wake?"
No oh, I come buy bread wey I go
chop for dream.
.
5. You see woman wey born new
pikin u ask her "madam u don
born? " No ohhhh, she buy am
for OLX...
.
6. You greet person "good
morning ma" ! She ask, my pikin
you don wake????
no ohhhh, I dey sleep walk...
.
7. My guy ask me "O boy where u
dey?" I tell am say i dey bank, nd
him ask me "Wat is happening
there?"
Nah new yam festival.. *LMAO*
.
8. My neighbour sees me
opening the gates to drive out
and asks me, U dey comot?
Not at all... I be the new
gateman...
.

9. I dey watch film… my guy enta
come ask me "Guy na film u dey
watch?
No naa... I dey discuss with
Osuofia...
.
10.U see me dey chop indomie
come dey ask me, O boy, na
indomie u dey chop so?
No ohhhh... Na fried rubber band
mixed with thread.


Lols.............. 

Comments

Popular posts from this blog

Relationships : Public Ex

News: Cultists kill mate at girlfriend's birthday party

Bedmatics: Bedroom Tactics!